Posts

Showing posts with the label Adenike-Gate-area

DISPLACEMENT EQUATION : HOW SATISFIERS IS TRYING TO TAKE OVER THE FOOD MARKET IN ADENIKE GATE AREA

Image
FOOD MARKET GOSSIP How una de, my people? Hope sey this short semester dey do una well well. I hear sey night class don start sef. I no go vex sey you no ask for pesin, the semester too short to think, bah? Make una sha dey chop well well. It is for your own good o, to hear sey pesin faint for exam don taya me to dey hear. Na so we esh o, we con talk sey make we branch AMAzing chop puff puff wey we neve chop since six months now. Omo! Come see as puff puff small, Ih be like sey we no even pay money at all. Shikini, shikini for ten-ten naira. Like sey that wan no do, ih no even sweet for mouth at all!  Anyway, No be the real reason I come here be that. Na so so question I con ask una today.  Ehn, YES! Abi na only me dey see the change wey shele for Adenike gate area so? The abracadabra movement of caravans and displacement of store owners in the area? The change pass APC sef.  Na so I siddon, hang leg dey sip Grey’s akamu when my antenna catch gis...