DISPLACEMENT EQUATION : HOW SATISFIERS IS TRYING TO TAKE OVER THE FOOD MARKET IN ADENIKE GATE AREA
FOOD MARKET GOSSIP
How una de, my people?
Hope sey this short semester dey do una well well. I hear sey night class don
start sef. I no go vex sey you no ask for pesin, the semester too short to
think, bah? Make una sha dey chop well well. It is for your own good o, to hear
sey pesin faint for exam don taya me to dey hear.
Na so we esh o, we con
talk sey make we branch AMAzing chop puff puff wey we neve chop since six
months now. Omo! Come see as puff puff small, Ih be like sey we no even pay
money at all. Shikini, shikini for ten-ten naira. Like sey that wan no do, ih
no even sweet for mouth at all!
Anyway, No be the real reason I come here be
that. Na so so question I con ask una today. Ehn, YES! Abi na only me dey see the change
wey shele for Adenike gate area so? The abracadabra movement of caravans and
displacement of store owners in the area? The change pass APC sef.
Na so I
siddon, hang leg dey sip Grey’s akamu when my antenna catch gist about one
displacement equation wey go shele for the “mini market”. Dem sey, a new oga
patapata don buy the land o and he don ask say make everybody vamoose for the
area, shap shap! Like play, like play, Mama buns, run comot go opposite, even
“Titi” wey get like three computer operation shops no fit beg make dem gree am.
My antenna no stop for there o, ih add say, the new oga na pesin wey get name ,
dey sell food for inside Adenike before.
Gbagaun! You sef dey think am?
Na Madam
Satisfiers! Madam wey try that time to get space for inside school, wey no get.
I no kukuma blame am. Sheybi if you dey find yellow and you see lemon, sheybi
color na sha colour? I no know sey the mini market fih contain close to 30
caravans until I see am with my two koro-koro eyes.
As sey that wan no do, she
dey follow dem mama wey dey opposite am do competition. On top the jollof ice
and colored green ice wey she dey sell, she still dey fry yam, fry potatoes
sell bread join am Ih con be like sey my antenna go soon change her name to
Madam shook mouth! Bet sha, as we dey look am, the women wey dey opposite am
still dey sell pass am o. Mama buns no dey even rest at all. Na to de ansa
customer everytime. The other day when I dey pass in front of satisfiers, na so
I hear her sales girl talk “aunty, food dey o, Porage dey o”, na so I con dey reason am, this
displacement equation don balance true true!
Comments
Post a Comment