DISPLACEMENT EQUATION : HOW SATISFIERS IS TRYING TO TAKE OVER THE FOOD MARKET IN ADENIKE GATE AREA

FOOD MARKET GOSSIP

How una de, my people? Hope sey this short semester dey do una well well. I hear sey night class don start sef. I no go vex sey you no ask for pesin, the semester too short to think, bah? Make una sha dey chop well well. It is for your own good o, to hear sey pesin faint for exam don taya me to dey hear.


Na so we esh o, we con talk sey make we branch AMAzing chop puff puff wey we neve chop since six months now. Omo! Come see as puff puff small, Ih be like sey we no even pay money at all. Shikini, shikini for ten-ten naira. Like sey that wan no do, ih no even sweet for mouth at all!



 Anyway, No be the real reason I come here be that. Na so so question I con ask una today.  Ehn, YES! Abi na only me dey see the change wey shele for Adenike gate area so? The abracadabra movement of caravans and displacement of store owners in the area? The change pass APC sef. 


Na so I siddon, hang leg dey sip Grey’s akamu when my antenna catch gist about one displacement equation wey go shele for the “mini market”. Dem sey, a new oga patapata don buy the land o and he don ask say make everybody vamoose for the area, shap shap! Like play, like play, Mama buns, run comot go opposite, even “Titi” wey get like three computer operation shops no fit beg make dem gree am. My antenna no stop for there o, ih add say, the new oga na pesin wey get name , dey sell food for inside Adenike before. 

Gbagaun! You sef dey think am?

 Na Madam Satisfiers! Madam wey try that time to get space for inside school, wey no get. I no kukuma blame am. Sheybi if you dey find yellow and you see lemon, sheybi color na sha colour? I no know sey the mini market fih contain close to 30 caravans until I see am with my two koro-koro eyes.

 As sey that wan no do, she dey follow dem mama wey dey opposite am do competition. On top the jollof ice and colored green ice wey she dey sell, she still dey fry yam, fry potatoes sell bread join am Ih con be like sey my antenna go soon change her name to Madam shook mouth! Bet sha, as we dey look am, the women wey dey opposite am still dey sell pass am o. Mama buns no dey even rest at all. Na to de ansa customer everytime. The other day when I dey pass in front of satisfiers, na so I hear her sales girl talk “aunty, food dey o, Porage dey o”, na so I con dey reason am, this displacement equation don balance true true!


Comments

Popular posts from this blog

[MUSIC]: J- Flag Feat Haydot Rock Dem Party(RDP)

Subject Combination For Lautech Post Utme